In WAEC examination, Akpos was asked to complete the following:
1) WAEC : He who fights and run away?
AKPOS : E don surrender be dat, na fear catch am
2) WAEC : A rolling stone?
AKPOS: No fit just dey roll, na person push am..
3) WAEC : He who lives in a glass house?
AKPOS : Na rich politician ego be…
4) WAEC : A stitch in time?
AKPOS : Dey prevent further tear tear…
5) WAEC : Birds of the same feathers AKPOS : Na de same mama born dem…
6) WAEC : One gud turn?
AKPOS : Na correct power steering fit do am…
7) WAEC : A bird in hand?
AKPOS : Wetin e wan be again? If no be barbeque…. Dem plenty for chicken republic
WAEC : Half a loaf is better than? AKPOS : beans and gari, soaking without sugar…
9) WAEC : A journey of a thousand miles?
AKPOS : Na de person wahala be dat,na why eno enter car or aeroplane jeje…
10) WAEC : He who laugh last?
AKPOS: Get brain problem, make dem examine am bcs na beginning of madness be dat…
11) WAEC : A patient dog?
AKPOS : Na hunger go kill am…
12) WAEC : All work and no play? AKPOS : Na bank job be dat bros…
13) WAEC : Once beaten?
AKPORS : Na revenge go follow be dat..
Watin he go score?"